Sunday, October 27, 2024

US election 2024: Michelle Obama make case for abortion rights as Trump gada support from Muslim leaders – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Vice President Kamala Harris (L) and former first lady Michelle Obama (R)

Former first lady Michelle Obama bin join Kamala Harris for Kalamazoo, Michigan, wia she tell di pipo wey bin attend di rally to “do somtin” ahead of di upcoming election on 5 November.

Obama, pesin wey Americans no too dey hear from, give speech wia she tell pipo make dem no sit around and complain – but instead go out go vote for di Democrats nominee, Harris.

Di former first lady tell voters to protect di kontri from di “dangers” of Trump, and also warn how di Trump administration fit impact abortion rights.

She say di former president fit take di US back into di days bifor Roe v Wade, a landmark case wey bin protect di right to abortion bifor di Supreme Court cancel am two years ago.

“I dey ask una, from di core of my being, to take our lives seriously,” Obama tok.

Republican presidential nominee, former U.S. President Donald Trump stand wit supporters on stage during campaign rally for Suburban Collection Showplace on October 26, 2024 for Novi, Michigan.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Republican presidential nominee, former U.S. President Donald Trump stand wit supporters on stage during campaign rally for Suburban Collection Showplace on October 26, 2024 for Novi, Michigan

Meanwhile, for Trump rally for Novi, Michigan, a group of Arab and Muslim community leaders bin join di former president on stage to endorse am and explain why dem dey back am.

Di largest Arab population for di US dey for Dearborn, Michigan, wey no far from wia Trump bin speak – and one of dose wey bin dey on stage na di mayor of Dearborn.

Gap between Trump and Harris dey narrow down

Di gap between Trump and Harris dey narrow for di polls as pipo kontinue to vote.

National polling averages show say Democratic nominee and Vice-President Kamala Harris get small lead over Republican nominee Donald Trump – Harris on 48%, Trump on 47%.

Towards di end of August, Harris bin almost dey four percentage points ahead of Trump but in recent days, dis gap don close, as you can dey see for di graphic below.

And while national polls fit give us small idea of how popular a candidate dey across di US, e dey important to consider di state polls for seven key battlegrounds states wey dis helpful guide by BBC Visual Journalism and Data teams unpicks.

Graphics wey show as di gap between Trump and Harris dey close for di opinion poll.
Wetin we call dis foto, BBC

Di polls dey close, and e no dey no dey clear which candidate go win.

But anoda question dey wey dey hang over dis election: sake of wetin bin happun last time, Trump go accept di election result if im lose?

Political gap fit be a major factor

Donald Trump dey enjoys a huge lead among men, while women tell pollsters say dem prefer Kamala Harris by a similarly large margin.

Di political gender gap reflects ten years of social change and e fit help decide di US election.

For di first woman of colour to secure presidential nomination, and only di second woman to ever come dis close, Kamala Harris dey go to great lengths not to tok about her identity.

“Listen, I dey contest becos I believe say I be di best person to do dis job at dis moment for all Americans, regardless of race and gender,” di vice-president bin tok for one CNN interview last month.

Latest article