Thursday, September 19, 2024

UAE lift ban on Nigeria: Nigerians fit obtain Dubai travel visa From July 15 with conditions – Minister – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Emirates Airline

Wetin we call dis foto, Emirates Airline

Nigerians now go fit apply for visas go di United Arab Emirates (UAE) from 15 July, 2024.

Di Minister of Information, Mohammed Idris wey announce dis informate tok say Nigeria government don reach agreement wit UAE to allow Nigeria Passport Holders get visa travel go di Arab kontri.

Di announcement dey come more dan two years afta di UAE suspend visa issuance to Nigerians.

“Following successful talks and extensive, mutually beneficial negotiations between di Government of di United Arab Emirates and di Government of di Federal Republic of Nigeria we reach agreement wey allow for di resumption of travel to di UAE for Nigerian passport holders.

Dis agreement include updated controls and conditions to facilitate obtaining a UAE visa.” Di statement tok.

Di minister say resumption of visas go dey effective from July 15, 2024.

Na for October 2022, United Arab Emirates, (UAE) put compulsory visa ban on Nigerians wey wan visit Dubai.

Di notice UAE give trade partners for Nigeria no provide reasons for dis ban but tok say, “all Dubai applications submitted don dey rejected,” e add say dem go send di rejections in batches.”

Wia dis foto come from, Mohammed Idris/X

Di updated conditions UAE give for Nigerians to get dia visa

One updated process don dey ground before pesin wey get Nigerian passport go fit apply for UAE visa.

According to one informate on dia website; to visit di UAE wit a Nigerian passport, e don become compulsory for di applicant to first get Document Verification Number (DVN) before dem fit apply for di visa.

Dis na in accordance wit di new visa issuance guidelines wey di goment of di United Arab Emirates establish.

Di statement add say, di regulation na to make sure say all di necessary documents dey digitally verified and authenticated before visa issuance.

Individuals wey dey below di age of 13 no need DVN for dia visa applications.

Aviation drama between UAE and Nigeria

Many disagreements bin dey ground between both goments and na di aviation sector suffer am di most.

For December 2021, Nigerian goment reduce di number of Emirates Airlines flight operations for Nigeria from 21 flights to one flight per week.

Di decision wey di goment say na to retaliate against di way di UAE goment take treat one local carrier, Air Peace.

Di UAE bin reduce Air Peace operations from three flights to one per week.

Di decision by di Nigerian goment force Emirates Airlines to stop operations for Nigeria for few weeks.

Operations later kontinu afta both goment settle.

For August 2022, Emirates Airlines announce suspension of all flight operations for Nigeria wit effect from 1 September.

Dem say di reason na dia inability to collect dia money wey dey trap for Nigeria.

For August 2023, president, Bola Tinubu, bin promise di citizens dem go soon resolve di dispute but since den di visa ban still dey in place.

Latest article