South Korea president Yoon Suk Yeol dey face impeachment sake of di martial law wey e declare.
Yoon Suk Yeol drastic decision – wey e announce inside a late-night TV broadcast – mention “anti-state forces” and di threat from North Korea.
But e soon become clear say no be external threats cause am but na im own desperate political palava.
For di center of di whole drama wey dey currently go on for di South Korea parliament, di impeachment process dey witness serious show.
Di opposition Democratic Party dey make move to impeach president Yoon and di parliament dey vote on Saturday on whether to do am.
Wetin happun for South Korea parliament
Di plenary session begin for South Korea National Assembly as di speaker remind di chamber members say di world dey watch and instruct dem to maintain decorum.
Lawmakers first vote on a special counsel investigation bill on di first lady bifor dem come move go di motion regarding di impeachment of President Yoon Yuk Seol.
Emotions just dey fly up and down during di parliamentary session as di lawmakers dey shout on one anoda across di floor od di assembly.
Bifor di impeachment voting, some members of di ruling People Power Party (PPP) begin leave di assembly to boycott di impeachment.
Meanwhile, na only eight members of di ruling PPP dey needed by opposition for di impeachment vote to pass.
Dis na becos two thirds of di parliament – 200 pipo need to vote in favour of di motion for am to pass, and di opposition get 192 lawmakers alreadi- dem just need eight more for di process.
But during di impeachment process, all members of di ruling PPP bin waka comot from di assembly remaining only one lawmaker– 107 waka comot.
As dem waka comot of di parliament, di crowd wey dey outside dey shout make dem go back inside.
Despite say members of di ruling PPP wey be di party of di president bin walk-out, di lawmakers kontinue di impeachment voting process.
Di motion go require 200 votes to pass.
How di impeachment process for South Korea be
Di impeachment process dey straightforward for South Korea. To succeed, e go need support from more dan two-thirds of di 300-member National Assembly – at least 200 votes.
Once impeachment dey approved, trial go happen bifor di Constitutional Court – a nine-member council wey dey oversees South Korea branches of government.
If six of di court members vote to sustain di impeachment, di president go dey removed from office.
If e happen, e no go be di be di first time wey a South Korean president dey impeached.
For 2016, dem impeach den-President Park Geun-hye afta e face accuse of helping one friend commit extortion.
For 2004 another president, Roh Moo-hyun, bin dey impeached and suspended for two months. Di Constitutional Court later restore am to office.
Yoon anyhow action shock di country – wey dey see imself as a booming, modern democracy wey don come far since im dictatorship days.
Many see dis week event as di biggest challenge to dat democratic society in decades.
Wetin be Martial law and im significance
Di implementation of martial law fit get legal impacts, such as di suspension of normal civil rights and di extension of military law.
Martial law in theory, dey temporary but e fit continue indefinitely.
Di last time dem declare am for South Korea na for 1979, when di country then long-term military dictator Park Chung-hee bin dey assassinated during coup.
Dem never invoke am since the country become a parliamentary democracy for 1987.
But on Tuesday, Yoon do am, wen e tok inside national address say e dey try to save South Korea from “anti-state forces”.
Yoon, wey don take a more hardline stand on North Korea dan leaders before am, describe di political opposition as North Korea sympathisers – without providing evidence.
Under martial law, di military dey get extra powers and civil rights dey dey suspended for citizens plus rule of law standards and protections.
Despite say di military announce restrictions on political activity and di media, protesters and politicians bone di orders. And no sign bin dey of government seizing control of free media – Yonhap, di national broadcaster, and other outlets bin continue to report as normal.