- Author, George Wright
- Role, BBC News
One plane wey carry 181 passengers don crash for one airport for South Korea.
At least 167 pipo die for di plane accident, di kontri fire service confam.
Di plane bin comot from di runway and crash inside one wall for di Muan International Airport for di south west of di kontri, di Yonhap news agency report.
Di Boeing 737-800 flight Jeju Jeju Air dey operate bin carry 175 passengers and six crew members, and dey return from Bangkok for Thailand. E crash as e dey land.
dem find two pipo alive so far – crew members wey dem see for di tail section of di aircraft.
Di passengers on board di flight include 173 South Koreans and two Thais, Yonhap report.
Di cause of di crash neva still dey clear, but local media bin report say if e be birds wey enta di plane systems cause am.
Unverified footage wey dem upload for social media of di crash – wey happun shortly afta 09:00 local time (00:00 GMT) – show as di aircraft skid off di runway and crash enta one wall, before part of am burst into flames.
Oda footage show one large plume of black smoke dey rise go di sky.
South Korea fire agency say dem don deploy 80 firefighters and more dan 30 fire trucks to di crash site.
Muan dey about 178 miles (288 km) south of di capital, Seoul.
Many pipo consider South Korea aviation industry to get solid track record for safety.
Dis crash na di first fatal accident for di history of Jeju Air, one of South Korea largest low-cost airlines, wey dem set up for 2005.
Dis na also di first fatal crash wey go happun for South Korean airline for ova a decade.
For 2013, three pipo die wen one Asiana Airlines flight crash as e dey land for San Francisco.
We still dey update dis tori!