Tuesday, October 15, 2024

Sean ‘Diddy’ Combs dey face accuse of assaulting teenager for new lawsuits – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

  • Author, Samantha Granville & Christal Hayes
  • Role, BBC News, Los Angeles

Sean “Diddy” Combs dey face new allegations of rape, sexual abuse and sexual assault afta some pipo file fresh lawsuits on Monday.

Two women and four men file at least six lawsuits for New York federal court. Dem include allegations go back as far as 1995 to 2021.

Di unnamed accusers allege say some of di assaults happun for Oga Combs’ parties, wey ogbonge celebrities and music artists attend.

Lawyers for Oga Combs deny di allegations, di statement to BBC dem say im ” nevA sexually assault anyone – adult or minor, man or woman”.

One of di accusers say im bin dey 16 years wen im attend one of di parties for Hamptons for 1998. For di lawsuit, im describe how belle bin sweet am to get invitation to Oga Combs’ party, wey become ogbonge A-list annual event for celebrities.

Di accuser say im bin see plenty celebrities and music artists as im bin dey waka around, and add say jam Oga Combs as im bin dey go bathroom. Im start to talk Oga Combs about breaking into di music industry wen dem bin go somewhere more private.

Di accuser allege say during dia conversation, Oga Combs just order am to undress.

Di lawsuit include photo of two of dem together for di party di teenager face bin dey blurred out.

According to di lawsuit, Oga Combs say na “a rite of passage” and “di route to becoming a star”. Di rapper bin tell di teenager say im fit make anybody to be star and di teenager bin get di right “look”, di lawsuit states.

Hundreds of pipo - dey wear  white - and gada around pool and tents wey dem cover white curtains.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Sean “Diddy” Comb’s party na annual tradition wey celebrities from Ashton Kutcher and Justin Bieber to Mariah Carey and di Kardashians attend

Anoda lawsuit wey dem file on Monday includes allegations by one woman wey claim say Oga Combs bin rape her for one hotel room for 2004 wen she be 19-year-old college student.

According to di lawsuit, she bin meet di music mogul for one photoshoot, where im come invited her and a friend to attend a private party for im hotel. Once dem arrive, di lawsuit allege say Oga Combs “fondled, molested, and ultimately raped her” even though she tell am many times to stop.

Texas-based lawyer Tony Buzbee, wey dey represent diaccusers, say im dey represent more dan 100 pipo wey dey plan to sue di rapper on allegations of sexual assault, rape and sexual exploitation.

Oga Buzbee say some of di alleged victims include children. Im say di lawsuits dem bring am under di Victims of Gender-Motivated Violence Protection Act, wey dey allows victims to file older claims.

“We go let di allegations for di filed complaints speak for themselves, and we go work to see say dem get justice,” Oga Buzbee tok for statement afta im fie di lawsuits on Monday.

“We expect to file many more cases ova di next several weeks wey go name Oga Combs and odas as defendants as we continue to gada evidence and prepare di filings.”

Di lawsuits na di latest of more dan a dozen pipo wey don file against Oga Combs recently, dem dey accuse di music mogul of assaults, rape and sexual extortion.

Im don deny all civil and criminal claims against am.

Oga Combs dey face federal criminal charges of racketeering and sex trafficking. Last week one judge tentatively schedule im trial to begin on 5 May 2025.

Latest article