Thursday, January 9, 2025

Sam Altman: ChatGPT creator say e no rape im sister as pikin – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

ChatGPT creator Sam Altman sister, Ann Altman, don file lawsuit wey accuse am say e bin regularly sexually abuse am between 1997 and 2006.

Di lawsuit wey dem file for 6 January allege say di abuse bin start wen she be three years and oga Altman be 12.

Warning: dis tori get some informate wey fit disturb you.

Oga Altman say e dey give im sister monthly allowance, pay her bills and rent and even bin offer to buy am house but say she “continue to dey ask for more money from us”.

But Ms Altman claim say her broda bin “groom and manipulate” and and do sex acts on am for many years wey include “rape, sexual assault, molestation, sodomy, and battery”, according to court filing wey BBC see.

Ms Altman say she bin get “great bodi injury”, ogbonge emotional distress and depression.

She bin add say she don get plenti medical bills becos of medical and mental health treatment she get for her injuries.

For di UK, victims or alleged victims of sexual offences get right to lifetime anonymity but di law no apply to pipo for di US.

Oga Altman tok say “ova di years we don try many ways to support Annie and help am to find stability”. E add say e don get “professional advice” on how to “dey supportive” witout say e dey “enable harmful behaviours”.

Di statement add say, “di mata don cause ogbonge pain to our whole family”.

Di lawsuit tok say di last time di alleged abuse happun na wen oga Altman already be adult and she still be pikin.

Ms Altman bin don make similar allegations against her broda bifor on social media platforms like X.

Billionaire Altman wey marry Oliver Mulherin for 2024 na one of di biggest figures for world wen e come to technology.

For late 2022, Open AI start di ChatGPT generative AI chatbot. Dem don dey use am worldwide for di ability to create computer code, emails, recipes and oda kind of texts and also image wey dey based on prompts.

For 2024, Oga Altman go back as Open AI oga just days afta di board bin sack am.

Additional reporting by Lily Jamali and Faarea Masud

Latest article