Tuesday, September 24, 2024

Russia-Ukraine war latest news today: Zelensky say di conflict fit end sooner dan some pipo tink – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

Ukrainian President Volodymyr Zelensky don tok say di war wit Russia fit end sooner dan some pipo tink.

“I tink say we dey closer to peace dan we tink. We just gatz to dey veri strong, veri strong,” e tok.

Wen im speak wit US broadcaster ABC News, Zelensky also tok say di victory plan e go present to US President Joe Biden dis week go require Ukraine allies to “strengthen” di Ukrainian army.

Zelensky tok say di plan no be about negotiating wit Russia, but rather na “a bridge to a diplomatic way out, to stop di war”.

E add say Ukraine fit only push Russian President Vladimir Putin to end di conflict if Kyiv dey come from a “strong position”.

On Tuesday, Kremlin tok-tok pesin Dmitry Peskov say Russia dey cautious about media reports of a Ukrainian plan and add say di conflict go only end wen Russia aims dey achieved.

Zelensky don ask Western kontris to allow Ukraine to ease restrictions on di use of long-range missiles wey fit dey used to strike deep into Russia and e dey expected to do so again dis week as e visit di US.

On Sunday, Biden tok say e neva decide weda to give Ukraine di green light. Zelensky tok say di US go need to lead di decision: “Evribodi dey look up to [Biden], and we need dis to defend oursefs,” e tell ABC.

Zelensky go tok at di UN General Assembly on Wednesday and e also dey expected to meet US presidential candidates Donald Trump and Kamala Harris.

Di president of di Czech Republic, Petr Pavel, tell di New York Times say Ukraine go need to dey “realistic” about dia prospects of recovering di areas in di east of di kontri wey Russia don manage to gain ova di last 31 months of war.

Im add say di outcome of di war go likely be dat some part of Ukrainian territory go remain under Russian occupation for some years.

Di defeat of either Ukraine or Russia “no fit just happun”, Pavel tell Times, adding dat di end of di conflict go dey “somwia in between”.

Zelensky US trip come as Ukraine continue to dey under attack by Russia.

In daytime attack on Tuesday, Russia hit high-rise apartment block for Ukraine northeastern city of Kharkiv.

At least three pipo die and 15 injure in di attack, wey local authorities tok say na glide bombs dem use carry am out.

On Monday night, attack on di eastern Ukrainian town of Poltava destroy infrastructure, while in di southern city of Zaporizhzhia one pesin die and six odas injure sake of “massive air strikes”.

Russian troops don make serious advances in di east and dem dey close Vuhledar – one city in di southern part of di Donbas front line wey Russian don dey try to seize since di beginning of dia full-scale invasion.

Ukrainian military expert and retired colonel Kostyantyn Mashovets warn im fellow Ukrainians say dem go need to dey “psychologically prepared” for di loss of Selydove, Toretsk and Vuhledar in di eastern region of Donbas.

“I go love to dey wrong,” e write on Facebook.

“But from di information I get… dis scenario of events fit happun in di near future.”

Latest article