Thursday, October 10, 2024

Ratan Tata: Di ‘modest’ Indian tycoon of Tata Group wey die at 86 – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

Entrepreneurs, academics, celebrities and politicians mourn di passing of Indian tycoon, Shri Ratan Tata Ji wey die for Mumbai on Wednesday at di age of 86.

India Prime Minister Narendra Modi tok say Tata na “visionary leader, compassionate and extraordinary human being” wey dey committed to making society better.

India prime minister tok say im passion towards development and giving back “championing tins like education, healthcare, sanitation, animal welfare to name few.”

Asian richest man, Mukesh Ambani, wey be friend wit am tok say e dey grief di loss of im “dear friend”

“Ratan Tata na visionary industrialist and philanthropist, wey always strive for society greater good.” Ambani tok.

For im condolence message, Google CEO Sundar Pichai, tok say Tata don leave behind “extraordinary business and philanthropic legacy, wey dey instrumental in mentoring and developing modern business leadership in India.”

Popular Bollywood actor, Amitabh Bachchan, describe Tata, as respected, humble, visionary leader of immense foresight and resolve.”

Cornell University, wia Tata graduate as alumnus issue statement afta im death, di university tok say dem remember di tycoon for im generosity and di extraordinary legacy e leave behind for India, across di world and Cornell.”

Tata Group don release statement to announce di death of Ratan Tata recognising im accomplishment in di company wey im take ova for1991 and retire for 2017.

“Tata take di helm of di conglomerate in 1991, just as India dey launch radical reforms wey open up im economy and set am on di path to become one of di world fastest-growing economies,” di statement tok.

“Under im leadership Tata Group grow into sprawling global business empire dat span multiple industries from software to sports cars. He head some of di group most high-profile business including British tea company Tetley, Anglo-Dutch steelmaker Corus, and UK-based luxury car brands Jaguar and Land Rover.”

Skip Twitter post, 1

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 1

Skip Twitter post, 2

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 2

Skip Twitter post, 3

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 3

Skip Twitter post, 4

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 4

Who be Ratan Tata?

prime minister

Wia dis foto come from, @NARENDRAMODI/X

Born in 1937, Ratan Tata na di great-grandson of Jamsetji Tata, di founding father of Tata Group ova one century ago.

Like odas for im family Tata join di family business in 1962. Afta studying architecture from Cornell University in di United States in 1962.

E take ova from im uncle as CEO for 1991 until e retire for 2017.

Tata Group get nearly100 companies, in automobile, steel, food, aviation, beauty, among odas. Tata design and build di first car model in India.

In 2017, Tata retire as chairman of di Tata Sons wen dem appoint Natarajan Chandrasekaran as chairman of di Tata Group.

Latest article