Despite di wahala wey she face, Miss Universe Nigeria Chidimma Adetshina don finish for di first-place position for di Miss Universe 204.
Dis na afta she enta di top five among all di contestants wey compete wit her.
Dis year Miss Universe 2024 na di 73rd Miss Universe pageant and e hold for Arena CDMX for Mexico City, Mexico on Saturday 16 November, 2024.
Wit smile, glamour and confidence, Chidimma perform well for all di stages wey reach for di competition.
Howeva, na Miss Denmark win di Miss Universe 2024 afta beating all oda contestants. She beat 129 odas to win di top prize.
Reigning Miss Universe, Sheynnis Palacios of Nicaragua crown di new Miss Universe.
Chidimma na di only African wey reach top 12 for di Miss Universe 2024.
For di final round, Chidimma ansa kwesion about ‘respect’.
“Which one dey more important to you. To be respected or liked and why?”, di judge ask.
Wit smile on her face, Chidimma say “I feel say like, na to dey respected. I feel like wen you respect yoursef and respect dos wey dey around. Respect dey veri important.”
Tension fill di hall wen di final contestant take her kwesion and dem begin dey announce di positions.
Top five Miss Universe contestants
Victoria Kjaer- Denmark (Winner)
Chidimma Adetshina- Nigeria (First Place)
Maria Fernanda Beltran- Mexico (Second Place)
Suchata Chuangsri- Thailand (Third Place)
Ileana Marquez- Venezuela (Fourth Place
Meanwhile, South Africa representative Mia Le Roux withdraw from di Miss Universe 2024 competition just before di grand finale.
Inside statement for di social media page of Miss Universe South Africa, dem say she pull out sake of health concerns.
Di statement bin come on di night wen di preliminaries of di Miss Universe competition bin happun and fans bin dey expect di South African representative to waka di stage but she no show up.
How dem choose di winner ?
Na about 130 contestants for di 73rd Miss Universe land for Mexico since ending of October and dem attend several functions since 1 November like galas, cocktails and go on tours and excursions.
But Preliminaries and National Costume Show wey happun on 14 November witness different shades of beauty and elegance.
Some of di selection stages include voting of di candidate into di top selected candidates for di Semifinals to advance into di Finals.
Also dem do Best Costume competition wey dey open to fans wit oda potential voting scenarios wey dem use select who progress go next stage.
For November 16, 30 selected candidates parade inside a swimsuit round, wia 18 of dem comot di competition.
Di 12 wey kontinu (semi-finalists) parade for evening dress wia anoda seven dey eliminated from di contest.
Di remaining five finalists come undergo a final kwesion from di jury, wey determine di final positions and di winner.