Friday, December 20, 2024

Malaysia Airlines Flight MH370: Goment approve new search for missing flight wey get 239 pipo on board – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

  • Author, Koh Ewe
  • Role, BBC News

Di Malaysian goment tok say dem don agree in principle to resume di search for one passenger jet wey vanish 10 years ago, wey be one of aviation greatest mysteries.

Malaysia Airlines Flight MH370 bin disappear for March 2014 on im way to Beijing from Kuala Lumpur wit 239 pipo inside di plane.

Efforts to locate di wreck of di Boeing 777 neva yield any result and hundreds of families of dose wey dey inside di plane remain haunted by di tragedy.

On Friday, Malaysia transport minister Anthony Loke say di cabinet bin approve in principle a $70m (£56m) deal wit US-based marine exploration firm Ocean Infinity to find di aircraft.

Under a “no find, no fee” arrangement, Ocean Infinity go get paid only wen dem find di wreck.

One 2018 search by Ocean Infinity under similar terms bin end unsuccessfully afta three months.

One multinational effort wey cost $150m ended for 2017 afta two years of scouring vast waters.

While di goment don “in principle” accept Ocean Infinity offer, Loke say negotiations ova specific terms of di deal still dey go on and go dey finalised early next year.

Di new search go cover a 15,000 sq km patch for di southern Indian Ocean, based on new data wey Kuala Lumpur find to dey “credible”, di minister tok.

“We hope dis time go dey positive,” Loke yok, and add say finding di wreck go give closure to di families of dose wey dey inside di plane.

‘Best Christmas present eva’

Relatives of passengers on MH370 bin welcome di Malaysian goment approval of a new search.

“I dey so happy for di news… E feel like di best Christmas present eva,” Jacquita Gonzales, di wife of MH370 inflight supervisor Patrick Gomes, tell di New Straits Times.

“Dis announcement stir mixed emotions – hope, gratitude, and sorrow. Afta nearly 11 years, di uncertainty and pain of not having answers don dey incredibly difficult for us,” Intan Maizura Othaman also tell di papers. Her husband, Mohd Hazrin Mohamed Hasnan, na member of di cabin crew.

Jiang Hui, wey im mama bin dey on di plane, tell Reuters news agency say di Malaysian goment gatz get a “more open approach” to di search to allow more players to take part.

Flight MH370 bin take off from Kuala Lumpur for di early hours of 8 March 2014. E bin lose communication with air traffic control less dan one hour afta take-off and radar show say e bin deviate from im planned flight path.

Investigators generally agree say di plane crash somwia in di southern Indian Ocean – though e no dey clear why e happun.

Pieces of debris, believed to be from di plane, don wash up on shores of di Indian Ocean in di years afta di disappearance.

Some conspiracy theories don come up around di aircraft disappearance. Some pipo say di pilot bin deliberately bring down di plane, while some also say na foreign military shoot down di plane.

One 2018 investigation into di aircraft disappearance find say di plane controls bin likely deliberately dey manipulated to take am off course, but conclusion no dey about who bin dey behind dis.

Investigators tok for dat time say “di answer fit only dey conclusive if dem find di wreck”.

Latest article