Dem don charge five pipo in connection wit di death of One Direction singer Liam Payne for Argentina, di authorities there tok.
Di 31-year-old star die on 16 October afta e fall from di third-floor balcony of one hotel for Buenos Aires.
Argentina Prosecutor Office tok say dem don charge di hotel manager, Gilda Martin, and di receptionist, Esteban Grassi, plus Payne friend Roger Nores wit manslaughter.
Ezequiel Pereyra – wey also work for di hotel – and Braian Paiz, wey be waiter dey charged wit accuse of supplying drugs.
Under Argentina legal system, di prosecutor office go gather evidence and dem go later present am to di judge, wey go decide weda to proceed to trial.
According to one statement wey di prosecutor office release, Judge Laura Bruniard don already take di decision to proceed to di next stage on Friday.
Di defendant lawyers fit appeal against dat decision. If dia appeals no dey successful, di trial phase go start.
In court documents, Judge Bruniard bin list di charges against di five suspects, wey dem refer to by dia initials, as na di custom for court documents for dis stage of di proceedings.
Hotel employee EDP dey suspected of selling cocaine to Liam Payne on 15 and 16 October.
Waiter BNP also dey suspected say e sell cocaine to Liam Payne two times on 14 October.
Payne friend RLN dey suspected of manslaughter say e allegedly “fail to fulfil im duties of care, assistance and help” towards di singer afta e “abandon am to imself and e know say e no fit care for imself. E also know say Payne dey suffer from multiple addictions”.
Hotel Manager GAM dey suspected of manslaughter say e allegedly fail to stop Payne from being taken to his hotel room moments bifor im death. According to di court papers, wit Payne state, di room balcony pose a “serious threat” and di manager suppose don ensure say dem keep Payne in a safe place until medical help arrive.
Chief receptionist ERG also dey suspected of manslaughter say e allegedly ask three pipo to “drag” Payne, wey no fit stand up, to im room, instead of make e keep am safe.
Judge Bruniard tok say she no think say Liam Payne friend, di hotel manager and di receptionist “bin plan or want di death of Payne” but dia actions bin create “risk” to im life.
If found guilty, di three fit face sentences of between one and five years in prison.
Di sentence for supplying drugs dey more serious and e range between four and 15 years in jail.
Judge Bruniard don order say make di two wey chop accuse of supplying di drugs remain for custody.
Dem ask dem to appear for court within 24 working hours.
For November, di prosecutor office tok say toxicology tests bin reveal traces of alcohol, cocaine and a prescription antidepressant for Payne body.
One post-mortem examination bin determine di cause of im death as “multiple trauma” and “internal and external haemorrhage”, wey be as a result of di fall from di hotel balcony.
According to di prosecutor office, medical reports also suggest say Payne fit don fall into a state of semi or total unconsciousness.
Di prosecutor office say dis don rule out di possibility of a conscious or voluntary act by Payne, and dem bin conclude say di singer no know wetin e dey do and e no get understanding of im actions.
Rogers Nores wey follow US celebrity news outlet TMZ tok afta Payne death, tok say im be “very good friend” of di singer and dem bin spend time togeda on di day di star die.
E say Payne “appear playful and happy” wen e leave am about one hour bifor di musician fall from di balcony.
Afta Payne death, police see substances for im hotel room and objects and furniture wey dem don damage.
Hotel staff bin make two calls to emergency services, dem say dem get one guest wey don take “too many drugs and alcohol”, and dey “scata di entire room”.
Payne become one of di most recognisable names in pop afta e show on The X Factor and rise to fame wit di boyband One Direction for di 2010s bifor di band go on indefinite break for January 2016.
Dem hold di singer funeral for Amersham, Buckinghamshire, for November.
Im former bandmates Harry Styles, Louis Tomlinson, Niall Horan and Zayn Malik dey among di mourners, alongside Payne girlfriend Kate Cassidy and im former partner Cheryl, wey dem get one son togeda.