Friday, September 27, 2024

Iwao Hakamada: Who be di world longest-serving inmate on death row wey Japan just free and why – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Iwao Hakamada bin don dey wait for im potential execution for 56 years

  • Author, Gavin Butler and Shaimaa Khalil
  • Role, BBC News in Singapore & Tokyo

One Japanese court don free 88-year-old man wey be di world longest-serving prisoner wey dey on death row.

Di court free am afta dem discova say di evidence dem use against am wey land am for jail na fake.

Dem find Iwao Hakamada, wey don dey on death row for almost half a century guilty for 1968 on top accuse say e kill im boss, di boss wife and dia two teenage children.

Na recently court grant am retrial of di case, as suspicions bin dey say investigators fit don plant evidence wey make dem sentence am for quadruple murder.

Di 46 years e spend on death row don take heavy toll on Hakamada mental health, e no even fit attend di hearing wia dem finally declare say im dey innocent.

Hakamada case na one of Japan longest and most famous legal sagas. E bin attract widespread public interest, as some 500 pipo line up for seats for di courtroom for Shizuoka on Thursday.

As di judge announce di verdict, Hakamada supporters wey dey outside di court begin shout “banzai” – one Japanese exclamation wey mean “hurray”.

Hakamada, wey dey exempted from all hearings sake of im deteriorated mental state, don dey live under di care of im 91-year-old sister Hideko since 2014, wen dem free am from jail and grant am retrial.

She bin fight for years to clear im name. She tok say e dey sweet to hear di words “not guilty” for court.

“Wen I hear am, I bin dey so moved and happy, I no fit stop to cry,” she tell tori pipo.

Her brother bin don tok bifor now say im battle for justice be like say “im dey fight for boxing ring evriday”. “Once you reason am say you no fit win, path to victory no dey be dat,” e tell AFP news agency for 2018.

‘Bloodstained’ clothes inside tank

Hakamada na former professional boxer. E bin dey work for one miso processing plant for 1966, wen dem recova di bodis of im employer, di man wife plus dia two children from one fire incident for dia house for Shizuoka, west of Tokyo. All four of dem bin de stabbed to death.

Authorities bin accuse Hakamada of murder, say na im murder di family, set fire to dia house and tiff 200,000 yen in cash.

Hakamada bin initially deny say im rob and murder di victims, but e later give wetin e describe as forced confession afta beatings and interrogations wey pass more dan 12 hours a day.

For 1968, court bin find am guilty of murder and arson, and dem sentence am to death.

Crowd of pipo bin hold one banner wey read "innocent man, not guilty verdict" alongside one foto of Iwao Hakamada

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Hakamada supporters outside di court bin shout “banzai”, one Japanese exclamation wey mean “hurray”, as di court announce di verdict

Di case wey bin drag for many decades, bin take a different turn wen investigation bin discover some clothes for inside di tank of di miso, one year afta Hakamada arrest. Na dose clothes, wey reportedly dey bloodstained, dem use set am up.

For years, however, Hakamada lawyers bin argue say di DNA dem recova from di clothes no match im own.

E bin raise di possibility say di items fit belong to someone else.

Di lawyers bin also suggest say police fit don fabricate di evidence.

Dia argument bin no dey enough to persuade Judge Hiroaki Murayama, wey bin note for 2014 say “no be di defendant get di clothes”.

Free at last

“E dey unjust to detain di defendant further, as di possibility of im innocence don become clear to a respectable degree,” Murayama tok at di time.

Den dem release Hakamada from jail and grant am retrial.

Prolonged legal proceedings mean say e take dem until last year to begin di retrial – and until Thursday morning for di court to declare di verdict.

Di details of wetin finally clear am for di case na di nature of di red stains on di clothes prosecutors bin claim say na im own.

Di defence bin question how di stains no clean afta many years. Dem tok say di fact say di stain still dey red and no turn black afta extended time dem put am for soybean paste mean say di evidence dey fabricated.

Thursday ruling see say “investigators bin tamper wit di clothes by putting blood on dem” wey dem come hide for di tank of miso, according to AFP.

Di court declare Hakamada innocent.

One woman dey set plates of food on top dining room table wia one man wey wear singlet sidon

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Hakamada 91-year-old sister, Hideko, don dey care for am since dem release am from jail for 2014

Decades of detention, mostly fir solitary confinement plus di eva-present threat of execution, don take heavy toll on Hakamada mental health, according to im lawyers and family.

Im sister for long bin beg for im release. Last year, wen di retrial start, Hideko bin express relief and say “finally dis weight don comot from my shoulders”.

Retrials for death row inmates no dey common for Japan – Hakamada na only di fifth pesin for Japan post-war history.

Along wit di United States, Japan na di only G7 kontri wey still dey impose capital punishment. And dem dey tell death row prisoners of dia hanging just a few hours in advance.

Latest article