Thursday, September 19, 2024

Israel strikes Lebanon: Hezbollah leader Hassan Nasrallah speech afta pager explosion – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Pipo sidon for coffee shop dey watch as Hezbollah leader Hassan Nasrallah give speech for Beirut

Kasala don start for Lebanon afta Israel launch air strikes on southern Lebanon.

Hezbollah leader Hassan Nasrallah bin condemn di fatal exploding devices attacks wey happun dis week.

Moments bifor Nasrallah read dia speech for television, Israel confam fresh strikes.

Our Correspondent for Beirut also hear as Israeli fighter jets breaking sound barrier over di capital

Nasrallah say di device attacks – wey kill at least 37 pipo na – “a declaration of war” and say Israel “no even consider innocent pipo”

More dan 2,600 pipo bin wound wen thousands of pagers explode on Tuesday and walkie-talkies explode on Wednesday

Multiple sources say Israel Mossad spy agency bin dey target Hezbollah. Israel neva tok about di mata, but on Wednesday, Defence Minister Yoav Gallant announce “a new phase for di war”

‘We go ansa dem’ – Nasrallah

Di speech wey Hezbollah leader, Hassan Nasrallah na im first public reaction since di plenti attacks for Lebanon in di last couple of days.

And pipo bin dey expect strong words from am against Israel.

For di speech im refer to di kontri as “di enemy” don cross “all limits, rules, and red lines” wit di explosions wey kill at least 37 pipo and wound more dan 3,000 pipo.

Im describe di attacks as massacre, and agree say di attacks na big blow for di group but dia ability to command and communicate still dey intact.

Im add say dem don launch one investigation to chook eye into how e happun.

“We fit call am war crimes or a declaration of war – anyhow you choose to call am, e dey okay and e fit di description. Dis na wetin di enemy bin plan,” im tok.

Im vow say demgo get beta punishment but, unsurprisingly, nobody bin know how dis response go be.

Di cross-border attacks on Israel go kontinu unless ceasefire dey for Gaza. im add say dem no go allow di pipo wey dey stay for northern Israel wey dey displaced sake of di kasala to comeback.

Di tone, again, show say di group go measure dia reaction so dat dem no go spark a major war wit Israel, wey fit spoil many times, not just for di group but e fit destroy Lebanon, a kontri wey dey struggle to recover from multiple crises in recent years.

Im add say for di last two days, Israel bin try to kill 5,000 pipo in two minutes, and say di blast na di first for di history of both Lebanon and di world.

We no doubt say “dem break in-to us”, im tok.

IDF says two soldiers killed near Lebanon border

published at 16:53 British Summer Time

Meanwhile di Israeli military say dem don kill two of dia sojas near Israel northern border wit Lebanon.

Di two men wey dey 43 and 20 years, “fell in combat”, dem tok for statement, dem add say na for near di Lebanon border dem kpai dem.

We go dey update dis tori

Latest article