Sunday, October 6, 2024

Israel-Hezbollah conflict map: Tracking di violence inside Lebanon – BBC News Pidgin

Must read

  • Author, By the Visual Journalism team
  • Role, BBC News

Israel don invade southern Lebanon for dramatic rise of dia kasala wit Hezbollah.

Di Israeli ground operation bin start on Monday night, dis na days afta on strike kill di leader of di Iran-backed armed group, Hassan Nasrallah.

Hezbollah don fire hundreds of rockets enta northern Israel and Lebanon don face two weeks of air bombing. Lebanese authorities say di attacks don kill ova 1,000 pipo and pursue up to a million pipo comot dia houses.

Israel don dey face-off wit Hezbollah for ova ten years but di war for Gaza don create one year of deadly cross border kasala between dem.

We go continue dey update dis page to fit explain di kasala.

Wia Lebanon dey?

Lebanon na small kontri wey get like 5.5 million pipo for inside.

E dey border Syria to di north and east, Israel for di south and di Mediterranean Sea for di west.

Na about 170km away from Cyprus.

Map wey show say Lebanon dey located for di Middle East, on di eastern shore of di Mediterranean Sea. Di capital, Beirut, dey on di coast and dey roughly for di middle of di country.

Wia di Israeli dey advance go?

Di Israeli Defense Forces (IDF) say e do “limited, localized and targeted ground raids” for southern Lebanon to dismantle wetin dem call di “terrorist infrastructure” of Hezbollah.

On Wednesday, wey be di second day invasion enta Lebanon, Israeli troops jam Hezbollah fighters for di first time, dis na according to BBC Nick Beake wey dey for northern Israel.

Columns of Israeli tanks for one undisclosed location for northern Israel, close to di border with Lebanon - 27 September 2024

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Israeli tanks for one undisclosed location for northern Israel last week

Di IDF say sojas don “eliminate terrorists and scata terrorist infrastructure wit precision-guided weapons and close-range engagements” for plenti southern Lebanese areas.

Later, di IDF announce say eight troops bin dey killed in action. Tori be say Hezbollah fighters ambush six and anoda two die for mortar fire.

Hezbollah say dia fighters bin fire anti-tank missiles sama Israeli commados for clashes for one border village. Dem also claim say oda troops bin dey targeted wit explosives and gunfire outside of Kar Kila. Na dia three Israeli Merkava tanks bin dey destroyed by missiles near Maroun al-Ras and clashes also dey Adalsseh and Yaroun.

Ground operation for southern Lebanon get plenti risks for Israeli forces. Southern Lebanon no get flat coastal plains like Gaza, na rolling hills wit some mountainous terrain dem get wey go make am hard for tanks to move easily witout fear of ambush.

Di thinking be say, Hezbollah get network of tunnels for di region. Di group don dey prepare for anoda full scale kasala wit Israel since di 34 day war for 2006.

Map wey show southern Lebanon, labelling Adaisseh, Yaroun and Maroun al-Ras, two Lebanese villages close to di border with Israel, and wey show di Litani River just north of Tyre and di Awali River just north of Sidon.

Di IDF don order pipo wey dey stay for some villages for southern Lebanon make dem dey comot go di north of di Awali River wey meet di coast about 50km from di border wit Israel.

IDF warn Lebanese civilians make dem no carry motor go south across di Litani river wey dey about 50km north of di border.

Na like one million pipo bin dey live for southern Lebanon bifor di kasala increase almost one year ago. Tens of thousands of pipo don dey run go north since Israeli airstrikes for di region increase for late September.

Israeli air defenses bin also dey in action again on Wednesday, di day afta dem block most of di ova 180 ballistic missiles wey Iran launch to Israel on Tuesday as do-me-I-do-you for di strike wey kill Hassan Nasrallak as well as one top Iranian commander.

Ova 240 rockets bin dey fired from southern Lebanon towards northern Israel throughout di day according to di IDF.

Isreal invasion of southern Lebanon come afta almost two weeks of serious air strike wey Israel say dey target Hezbollah for di south of di kontri, di eastern Bekaa Valley and di southern suburbs for Beirut.

Map show aerial attacks launched on Lebanon and Israeli between 18:00 GMT on 30 September and 18:00 GMT on 1 October. Most of di Israeli strikes don dey for locations for southern Lebanon, while Hezbollah attacks don dey mostly for northern Israel.

Israel say dem dey hama Hezbollah sites wey include weapons stores and ammunition dumps, but Lebanese officials say ova 100 women and pikin dem don die.

For Lebanese civilians wey dey try run comot from southern Lebanon, di main route to go north na di coastal road wey dey pass through di kontri but recently, areas by dat route don dey targeted by air strikes.

Most of di rockets wey Hezbollah fire target northern areas for Israel. But some rockets don reach south and scata houses near di coastal city for Haifa.

Di Israeli strikes for Beirut now dey focused for Dahieh, wey be southern suburb wey get thousands of civilians and get strong Hezbollah presence.

Map show di population density of Beirut and highlight di locations of some Israeli strikes on di Lebanese capital. Most strikes don dey on Dahieh suburb, wey be one of di most densely populated areas of di city.

Israel now dey inside kasala wit armed forces and non-state armed groups for several kontris for di region wey include Iran, Syria and Yemen.

Israel ballistic missile attack for Israel na di latest major escalation.

Wetin go happun next no clear but Israel don promise to respond as Prime Minister Benjamin Netanyahu describe di attack as “big mistake” wey Iran “go pay for”.

Map show say Israel dey fight on multiple fronts for di Middle East - Hamas for Gaza, Hezbollah for Lebanon, Syrian forces and Shia militia for Syria, Shia militia for Iraq, Iran, and Houthis for Yemen.

Latest article