Thursday, September 12, 2024

Israel-Gaza war: Di US ceasefire plan and di problems as Israel-Hamas war dey continue – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

Di US Secretary of State, Anthony Blinken, don tok say ceasefire fit dey for di war between Israel and Hamas for Gaza within days, afta dat Israel don accept im peace proposals on 19 August.

Di deal go involve end to hostilities for Gaza and di return of hostages wey Hamas and dia allies bin capture during dia raid into Israel for October 2023.

Di US bin don dey work to “bridge proposals”, to overcome di sticking points wey dey prevent Israel and Hamas to agree one deal.

Wetin be di main points of di US peace plan?

Oga Blinken bin don dey Israel, dey promote one peace deal base one plan wey di US president Joe Biden bin lay down for May dis year.

E go take place for three phases.

Di first go include one “full and complete ceasefire” wey last six weeks, di withdrawal of Israeli forces from all populated areas of Gaza, and di exchange of some of di hostages – including women, di elderly and di sick and wounded. Dem go dey exchanged for Palestinian prisoners wey dey for Israeli jails.

One child hostage return to Israel for November 2023

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For November 2023, 105 hostages bin dey returned to Israel and more dan 100 still dey Gaza

Di second phase go involve di release of all oda living hostages and one “permanent end to hostilities”.

Israel tok say more dan 100 hostages still dey held, and believe say 71 still dey alive. Four oda hostages don already dey Gaza bifor 7 October, two of wey dem believe say don die.

One deal wey dem agree for November 2023 see Hamas release 105 of di hostages during one week-long ceasefire in return for some 240 Palestinian prisoners wey dey Israeli jails.

Aerial view of ruined buildings in Gaza

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di peace deal go include one plan to rebuild Gaza

Di third phase of di peace deal go see di start of one major reconstruction plan wey dem draw up for Gaza, and di return of dead hostages’ remain.

One statement from di Israeli goment on 19 August tok say: “Di Prime Minister repeat Israel commitment to di current American proposal on di release of our hostages, wey take into account Israel security needs, wey e strongly insist on.”

Wetin be di problems for di peace plan?

E get tinkin say major differences still dey between Israel and Hamas.

One issue be say Israel military presence still dey for Gaza.

Israel say dem want troops to remain to stop Hamas regrouping, and to stop dem from smuggling in more arms.

However, Hamas dey against Israeli forces remaining for Gaza afta ceasefire.

E also get differences wit Israel on di number and identity of Palestinian prisoners wey go dey returned to Gaza in exchange for Israeli hostages.

Israeli troops dey patrol for Gaza

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Hamas nowant Israeli troops to occupy Gaza afta ceasefire

Wetin be di chances say dem go reach peace deal?

Oga Blinken don tok say ceasefire must dey reached urgently.

“Dis na decisive moment, probably di best, maybe di last opportunity to get di hostages home, to get ceasefire and to put evri one for beta path to endure peace and security,” e bin tok on 19 August, wen e dey Israel.

As dem don gain broad agreement from di Israeli goment, e bin travel to Cairo to tok wit Egyptian and Qatari mediators. Both kontris get channels of communication wit Hamas.

One Israeli demonstrator call for peace deal and di return of hostages

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Many pipo for Israel dey press for peace deal and di return of all remaining hostages

However, Hamas don tok say dem no go send representatives dia.

One Qatar-based member of di organisation political bureau, Basem Na im tok say: “We bin agree one deal [through mediators] on 2 July… and therefore we no need one new round of negotiations or to discuss di new demands of Benjamin Netanyahu.”

E bin tok say Hamas“still dey interested” for peace deal but say: “We don show maximum flexibility and positivity, and di oda party don understand dis as weakness and bin meet am wit more force – e no get interest to reach ceasefire, only for flaring up di region… and serve im own personal political interests.”

Israel goment don replie say Hamas dey “completely obstinate” and say “pressure need to dey directed” at di group.

One Israeli soldier tanda next to di entrance to one tunnel wey Hamas dey use for Gaza

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Israeli forces continue to uncover Hamas tunnels and destroy them

Di Israeli military bin launch one campaign for Gaza to destroy Hamas for response to one attack on southern Israel on 7 October, during wia about 1,200 pipo bin dey killed and 251 bin dey taken as hostage.

Since den, more dan 40,130 pipo don dey killed for Gaza, according to di territory Hamas-run health ministry.

Di fight dey continue, and Israel dey tok say for di past few days dem don tok say dem don destroy several Hamas compounds and one tunnel network wia rockets and missiles dey found, and don “eliminate dozens of terrorists”.

Palestinian media bin report say on Monday six pipo don dey killed for one Israeli air strike for Khan Younis, for di south of Gaza, and say anoda four dey killed for di strike on one car for Gaza City, for di north.

While Oga Blinken tok say e tink say peace deal fit dey reached soon, neither Israeli nor Hamas sources wey bin tok to di BBC dey as hopeful.

Latest article