Thursday, September 19, 2024

Donald Trump on Kamala Harris heritage: ‘Na black she be or Indian?’ – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

Donald Trump don question Kamala Harris’ racial identity during one heated exchange for one convention for black journalists.

Trump falsely claim say di vice-president and presumptive Democratic nominee no too tok about her Asian-American heritage until recently wen, e claim say “she turn to black pesin”.

“I no know say she be black until a number of years ago wen she happun to turn black and now she make pipo see her as black,” e tok for di National Association of Black Journalists convention for Chicago on Wednesday.

“So I no know – na Indian she be? Or na black she be?”

Ms Harris say Trump remarks na “di same old show” of “divisiveness… and disrespect”.

“Di American pipo deserve beta,” she tell pipo for one meeting of di historically black sorority Sigma Gamma Rho for Houston. “We deserve a leader wey understand say our differences no divide us – dem be di essential source of our strength.”

Small history of Ms Harris black heritage

Ms Harris na di first black and Asian-American vice-president, wey get Indian and Jamaican-born parents.

She attend Howard University, one historically black university, and join di largely black Alpha Kappa Alpha sorority.

She become member of Congressional Black Caucus afta she enta di Senate for 2017.

Trump claims bin generate heated exchange wit ABC News’ correspondent Rachel Scott, one of di moderators of di Chicago event.

“I respect either one,” di Republican bin tok as e dey refer to Harris’ racial identity. “But she obviously no know because she be Indian all di way and then all of a sudden she do u-turn and she become black pesin.”

White House press secretary Karine Jean-Pierre say no-one “get any right to tell someone who dem be, how dem identify. Dat no be anybody right.”

“Who appoint Donald Trump as di judge of Blackness?” Representative Ritchie Torres of New York ask. E described Trump as a “symbol of a racist past”.

Di Republican nominee and former president get history of attacking im opponents on di basis of race.

E bin falsely accuse Barack Obama, di kontri first black president, say dem no born am for di US.

Trump attack di former UN ambassador and im Republican primary opponent Nikki Haley as e falsely claim say she no fit be president because her parents n be US citizens wen dem born her.

Ms Harris don face series of attacks since she become di likely Democratic nominee. Republicans don criticize di decision, as dem say dem select her sake of her race.

Tim Burchett, one Republican congressman from Tennessee, call her a “DEI vice-president” – one reference to diversity, equity and inclusion programmes.

On Wednesday, Scott push Trump to clear am weda e believe say Ms Harris na “DEI hire”. E reply say: “Really, I no know, e fit be so.”

Ms Harris bin describe her growing up, she say she dey in touch wit her Indian heritage and dey often visit di kontri.

Her mama also allow her two daughters dey involved for di black culture of Oakland, California – wia she grow up, she tok.

Trump also attack Ms Harris’ credentials during di discussion, e say she fail her bar exam early for her legal career. Many pipo for di crowd murmur as e tok am.

“I just dey give you di facts. She no pass her bar exam and she no tin say she go pass am and say she go ever pass am and I no know wetin happun. Maybe she later pass am,” e tok.

Ms Harris bin graduate from di University of California Hastings College of Law for 1989.

Di New York Times report say she fail her first attempt and pass am di second time.

Di state bar of California tok say less dan half of those wey sit for di test dey pass am on di first attempt.

Di Chicago discussion bin start wit heated gbasgbos back and forth between Scott and di former president. Trump bin accuse di journalist say she give “very rude introduction” wen she start di tok-tok as she ask about im past criticism of black pipo.

She bin cite as Trump bin dey call black journalists’ questions ”stupid and racist” plus say e bin get ”dinner wit one white supremacist for your Mar a Lago resort”.

“I love di black population of dis kontri, I don do so much for di black population of dis kontri,” e respond.

Di former president criticise di conversation hours later on im social media platform.

“Di questions dey rude and nasty, often in di form of a statement, but we CRUSH AM!” e tok.

Latest article