US actress, Blake Lively don file legal complaint against im co-star, Justin Baldoni wey she follow do di feem It Ends With Us. She accuse am of sexual harassment and campaign to “destroy” her reputation.
According to di legal filing, she accuse Baldoni and im team say dem attack her public image.
Dis dey come afta one meeting wia she carry her actor husband, Ryan Reynolds to address, “repeated sexual harassment and oda disturbing behaviour” wey allegedly oga Baldon and anoda producer bin run.
Oga Baldoni lawyers tell BBC say di allegations na lie, say dem bin need to get crisis manager bicos Ms Lively say she go scata di movie if dem no meet her demands,
As at now, plenti Hollywood stars don dey tanda gidigba behind Ms Lively for di suit wey she file on top oga Baldoni head.
Fellow actresses, America Ferrera, Amber Tamblyn and Alexis Bledel comot wit joint statement on top Instagram, say, “as Blake friends and sisters of ova 20 years, we dey stand in solidarity wit her as she dey fight back against di reported campaign wey dem wan use spoil her reputation.
“Throughout di filming of It Ends With Us, we see her ginger courage to ask for safe workplace for her and her colleagues for set and we dey shocked to read evidence of premeditated effort to spoil her voice.”
Ferrera, Tamblyn and Bledel bin work wit Ms Lively for di 2005 feem, The Sisterhood of the Traveling Pants.
Di author of di book wey dem take do di feem, Coleen Hoover also follow show support say Ms Lively dey “honest, kind, supportive and patient. Never change, never wilt”.
She also repost di statement from di Ferrara, Bledel and Tamblyn wey she call “inspiring”.
Wetin di lawsuit dey about?
No be lawsuit per se, na wetin dem dey call legal complaint and e dey one step before lawsuit.
Di meeting wey hold on 4 January, 2024 between her and Mr Baldoni wey her husband Ryan Reynolds bin also attend even though im no dey part of di feem, bin also feature for di legal complaint.
Dem tok say di meting bin aim to address di “hostile work environment” for set.
For filing wey dem send give California Civil Rights Department dem bin list 30 tins wey Ms Lively put for ground as demands bifor dem go kontinu to dey produce di feem.
- Make dem no longer dey tok about oga Baldoni or di production company CEO, Jamey Heath, di former “pornography addiction” tell Ms Lively or oda colleagues
- Make dem no dey describe dia genitals tell Ms Lively
- And no more sex scenes, oral sex or on camera climaxing by Blake LIvely wey pass di one wey bin dey di script wen she join di project
- Make oga Baldoni stop to dey tok about how e fit follow her dead papa tok
Lively also accuse oga Baldoni and Wayfarer Studios wey cause di planning to spoil her reputation.
For statement wey her lawyers send BBC, Ms Lively say, “I hope my legal action go open curtain on dis kain do me I do you tactics wey dem dey use attack pipo wey tok outside about misconduct and help protect pipo wey fit dey targeted.”
To ansa di claim oga Baldoni lawyer Bryan Freedman sama back say na she bin cause gbas-gbos and now she dey lie put oga Baldoni, Wayfarer Studios and dia representatives.
Oga Freedman accuse Ms Lively say she bin make plenti demands and threats wey include say she “no go show up for set, or threatening say she no go promote di feem” wey go las-las “kill di feem during release if dem no meet her demands”.
Di drama behind di feem, ‘It Ends With Us’
Di feem, It Ends With Us, wey comot for August, na box office hit even though some critics say e dey romanticize domestic violence.
Soon afta e comot for cinema anoda co-star, Brandon Sklenar hint for Instagram post say gbege fit dey ground between Ms Lively and Baldoni.
E tok for im statement say “wetin happun or no happun behind di scenes no and hopefully no go distract from wetin we bin wan do wen we dey make di feem.”
Di rumour come carry more ginger wen for di red carpet for di premiere of di movie di two of dem no stand togeda for red carpet.
No be only di gbas-gbos wit di oga Baldoni, wey also direct di feem na im cause kasala about di feem, dem also yab di way di actors for di feem promote am.
Dem yab Blake say apart from Insta story she no really touch on di domestic violence of di movie as she dey use di time to promote her new make-up and drinks company. She even do interview wit her co-stars wey dem no tok about domestic violence.
It Ends With Us tell di tori of Lily Bloom, wey Ms Lively act, as she dey go through di love triangle wey she dey inside wit her abusive boyfriend, Ryle Kincaid, wey Mr Baldoni act as and her compassionate first love, Atlas Corrigan wey Mr Sklenar act as.
E dey based on best selling novel of di same name wey Coleen Hoover bin write.
Di 45 year old author don tok bifor say na di abuse wey mama face na im inspire her to write di book.
For interview wit BBC for di feem Premier for August, Ms Lively, wey also dey credited as producer, call out her character say, “Lily na survivor and victim and why na ogbonge labels, dem no be her identity. She define hersef and I tink e dey very inspiring say nobodi no fit define you.”