Sunday, December 15, 2024

Jay Z and Sean diddy Combs: Jay-Z beg make court dismiss rape lawsuit sake of victim inconsistencies – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

One lawyer for rapper Jay-Z don ask court to dismiss a lawsuit wey dem accuse am along wit Sean “Diddy” Combs say dem rape a 13-year-old girl for 2000.

Dis lawyer say na sake of inconsistencies wey emerge for her (di victim) allegation.

Alabama woman, wey her name for di legal action na anoda name Jane Doe, bin accuse di musicians say dem drug and attack her for a house party following di MTV Video Music Awards.

She claim say she speak wit one celebrity for di party, though im representative say e dey on tour for di time.

Her father tell NBC News say e no fit recall driving five hours to pick her up afta di alleged assault, as she tok.

For interview wit NBC, di woman agree say she make “some mistakes” for her accusation, but she say she stand by her claim.

Rape support providers say e dey common for victims of such assaults to forget some details, especially if dem don dey allegedly drugged.

How dis mattter take start?

Di litigation na part of dozens of sexual assault lawsuits wey dey filed against Mr Combs, wey dey for custody awaiting trial on federal sex-trafficking charges for New York.

Dem deny am bail for third time last month, but Mr Combs deny all di allegations.

Jay-Z lawyer, Alex Spiro, ask di court to dismiss Jane Doe case.

For one statement to di BBC, di attorney say: “E dey stunning say a lawyer no only file such a serious complaint witout proper vetting, but go make tins worse by further pushing dis false story for di press.”

Di rapper, wey im real name na Shawn Carter, issue a statement to di BBC say di lawyer, Tony Buzbee, don file di legal action “in pursuit of money and fame”.

“Dis incident no happun and yet e file am for court and double down to di press,” di statement tok.

“True Justice dey come. We fight from victory, not for victory. Dis dey ova bifor e start. Dis 1-800 lawyer no realize am yet, but, soon.”

Di BBC dey contact Mr Combs lawyer for comment.

Di rape allegation

Warning: Some part of dis tori contain detail wey fit worry some readers.

Mr Buzbee say im firm dey kontinue vet im client claims.

Di woman say for di lawsuit say a waitress offer her a drink for di party wey make her feel “woozy”, so she go inside a room to lie down.

Soon after, di legal action say, Mr Combs and Mr Carter enta di room wit a female celebrity wey dey described as Celebrity B.

Di legal action say Mr Carter hold down and rape her, bifor Mr Combs do di same, all wen Celebrity B dey watch.

Howeva, photos from dat evening show Jay-Z and Mr Combs for different location to di one wey di accuser bin describe.

E no dey clear if dia whereabouts for di entire evening dey accounted for.

Di woman claim for her allegation say she speak wit musicians Benji and Joel Madden, who she say dey among a number of celebrities for di house party.

She no accuse dme of any wrongdoing.

But a representative for di Maddens tell di BBC say di brothers dey on tour for di Midwest during di VMAs dat year.

Di woman father tell di NBC e no rememba driving more dan five hours to pick up im daughter afta di alleged ordeal.

“I feel like I go rememba dat, and I no rememba,” he say.

Di woman lawyer, Mr Buzbee, tell NBC say im client stand by her claim.

“Our client remains fiercely adamant say wetin she state dey true, to di best of her memory,” e say.

“We go kontinue to vet her claims and collect data wey dey to di extent e exist.

“Becos we don interrogate her intensely, she don even agree to submit to a polygraph. I neva get a client wey suggest dat bifor.”

Wetin di accuser tok

Di woman, wey don be 38 years now and a mother-of-two, tell NBC for di interview from Houston, Texas: “You should neva let wetin somebody else do ruin or run your life.

“I just hope I fit give odas di strength to come forward like I come forward.”

Erinn Robinson, director of media relations for di Rape, Abuse & Incest National Network (RAINN), say “trauma like rape fit get both short- and long-term effects on di brain wey dey influence decision making and memory.”

“Recall of memories fit dey small, and details fit no dey recalled for di right order,” she tell di BBC.

Ms Robinson say dis effects dey common and say police departments dey trained to deal wit such cases in order to reduce di likelihood of allegations wey dem dey dismiss becos di victim memory dey disjointed or inconsistent.

Latest article