Monday, December 23, 2024

Joe Biden pardons his son Hunter: Why US President issue ‘full and unconditional’ pardon for im son – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

United States President Joe Biden don pardon im son Hunter of firearms and tax convictions despite say im bin pledge say e no go use im presidential authority to grant am clemency.

Biden issue ‘full an unconditional’ pardon for Hunter on Sunday and yarn say im son dey “singled out” and “selectively, and unfairly” prosecuted sake of im family name.

“Effort dey to break Hunter – wey don dey sober for five and a half years, even in di face of unrelenting attacks and selective prosecution,” Biden tok for one statement wey White House release.

“In trying to break Hunter, dem try to break me – and reason no dey to believe say e go stop here. Enough is enough.”

Explaining im decision, Biden say throughout im career, e don follow di principle of telling di public di truth out of a belief say Americans dey fair-minded.

Reacting to di news, Hunter Biden put out one statement wia e tok say im don “admit and take responsibility for my mistakes during di darkest days of my addiction” and add say im no go take di clemency for granted

E dey common for presidents to issue a raft of pardons in di closing months of dia presidency, however Republicans don react negatively to dis one, and brand Biden “a liar” and “corrupt”.

President-elect Donald Trump don call di pardon an “abuse and miscarriage of justice”.

Presiden Elect Donald Trump don drop in own responce on di mata, for Truth Social wia he write say, “Shey di pardon wey Joe give Hunter go include di J-6 hostages wey don dey imprisoned for years. Dis kain abuse and miscarriage of Justice!”

Wetin e mean by di ‘J-6 hostages’ na im supporters wey bn storm di US Capitol on 6 January 2021 to try overturn Trump defeat for di 2020 election.

Latest article