Saturday, December 21, 2024

Kash Patel: Donald Trump pick ex-aide for FBI and Chad Chronister to DEA – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

US President-elect Donald Trump don pick former aide, Kash Patel, to lead di Federal Bureau of Investigation, one agency wey Patel often dey criticise.

Di former US defence department chief of staff for di first Trump administration, Patel na steadfast supporter of di incoming Republican president.

For Patel to take di job, the current FBI director Christopher Wray go need to resign or dey fired – although Trump no call on am to do so for im post.

Separately, Trump say e get plans to nominate Chad Chronister, sheriff of Florida Hillsborough County, as head of di Drug Enforcement Agency.

Patel and Chronister join Attorney-General nominee Pam Bondi for filling out Trump law enforcement pick.

Also on Saturday, Trump bin announce say e don select Charles Kushner to be ambassador to France.

Oga Kushner na real-estate developer and di father of Jared Kushner, husband of im daughter Ivanka Trump.

Di nomination show to be di first administration position wey Trump don formally offer to any relative since im re-election.

All three choices go need dey confirmed by one majority vote for di US Senate.

Patel na Trump loyalist wey dey share di president-elect suspicion of govment institutions.

“Kash na brilliant lawyer, investigator, and ‘America First’ fighter wey don spend im career dey expose corruption, defend justice, and protect di American pipo. ” Trump bin post on Truth Social, im social media platform, add say Patel na “advocate for truth, accountability, and di constitution”.

Im past proposals don include “dramatically” limit di FBI authority. For im memoir, Govment Gangsters, Patel bin call for eradication of wetin e call “govment tyranny” within di FBI by firing “di top ranks”.

Patel go replace current FBI director Christopher Wray, wey Trump bin appoint im 2017 for one 10-year term.

But Wray bin fall out of favour wit di president elect wen di FBI bin assist wit one federal probe into Trump handling of classified records, one case wey since don dey dropped.

For one statement following Trump announcement, di FBI say: Every day, di men and women of di FBI continue to work to protect Americans from one growing array of threats.

“Director Wray focus remain on di men and women of di FBI, di pipo wey do di work wit, and di pipo wey we do di work for.”

Di son of Indian immigrants, Patel na former defence lawyer and federal prosecutor wey bin catch Trump eye afta e become one senior counsel to di House of Representatives intelligence committee in 2017.

Trump bin hire am as national security aide in 2019 and one year later e dey appointed chief of staff to di head of di Pentagon.

As well as im 2023 memoir, e don publish two pro-Trump children books.

One of di titles, Di Plot Against di King, feature one villain, Hillary Queenton, wey dey try to depose King Donald, who dey aided by one wizard called Kash di Distinguished Discoverer.

Anoda villain na Keeper Komey – one thinly-veiled reference to former FBI Director James Comey – and im “spy slugs”, according to di book blurb.

Patel don often rally against di so-called “deep state”, wey some Americans believe say na unelected bureaucratic machine wey secretly dey run di kontri for sinister purposes.

Patel don also criticize di media, wey e bin call “di most powerful enemy di United States don ever see”.

E also dey on di board of Trump Media and Technology Group, wey own di incoming president social media platform Truth Social.

Patel reportedly get one consulting contract wit di company wey dey pay am at least $120,000 per year.

Chad Chronister and wife Nikki Debartolo wear coats and smile at the camera, as they are seen outside "Good Morning America" in New York City

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Chad Chronister and e wife Nikki DeBartolo during trip to New York City in 2020

Chronister also come wit one long background in law enforcement.

E don work in law enforcement in Florida for 32 years, according to im official bio, and e don serve as di top law enforcement officer for Hillsborough County, Florida, since 2017.

On social media, Trump don praise Chronister experience and reiterate im focus on drugs and di US border.

“As DEA Administrator, Chad go work wit our great Attorney General, Pam Bondi, to secure di border, stop di flow of fentanyl, and oda illegal drugs, across di southern border, and SAVE LIVES”, Trump write.

E bin write on social media, Chronister tok say e be “di honor of a lifetime to dey nominated” by Trump.

“I dey deeply humbled by dis opportunity to serve our nation.”

Latest article