Friday, November 22, 2024

Susie Wiles: Donald Trump first appointment, first female White House chief of staff afta US election – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

Afta e win di US election, president-elect Donald Trump don appoint im campaign co-manager Susan Summerall Wiles as di White House chief of staff.

Dis first appointment come on Thursday as Trump begin dey set who go dey for im cabinet as di 47th US president.

As di first US president wit criminal conviction to win America presidential election, Trump describe Susan Wiles as a tough and smart pesin.

For statement, Trump say Wiles help am achieve im greatest political victory for American history.

“She dey tough, smart, innovative, and dey universally admired and respected”.

For history, Susan Wiles wey be 67 years old go be di first-eva female wey any president go appoint as chief of staff for di US.

“Na well deserved honour to have Susie as di first-eva female chief of staff for United States history. I no get any doubt say she go make our kontri proud,” Trump tok.

According to Trump, di new chief od staff bin like to dey work from di back but she dey knwn as one of di most feared political operatives for di US.

Who be Susie Wiles?

According to a profile by Politico earlier dis year, dem describe Susie Wiles as pesin wey dem fear but no to sabi.

Less dan a year afta Wiles start dey work for politics, she join Ronald Reagan campaign ahead of di1980 election.

She play a key role to change politics for Florida wia she dey live.

For 2010, she turn Rick Scott wey be businessman wit little political experience, to become govnor of Florida for just seven months. Scott don become a US senator now.

Wiles meet Trump during di 2015 Republican presidential primary and become di co-chair of im Florida campaign.

Trump go ahead to win Florida ova Hillary Clinton for 2016.

Florida Gov Ron DeSantis, wey put her in charge of im successful gubernatorial race two years later bin describe Wiles as “di best for di business”.

Wiles work on di Trump campaign alongside Chris LaCivita, a veteran of Republican politics wey get years of experience.

Di two of dem work wit Trump to form a winning presidential primary strategy.

For her Politico profile, di 67-year-old grandmother – wey be di daughter of late American football player and broadcaster Pat Summerall – say she come from a “traditional” political background.

Dis new chief of staff dey considered to be di president top aide, and go play a crucial role for everi president administration.

She dey important to serve as di manager of di White House and dey responsible for putting togeda president staff.

As chief, she go lead di staff through di Executive Office of di President and oversee all di daily operations and staff activities.

She go also advise president on policy issues and dey responsible for directing and overseeing policy development.

Wen dem go swear-in Trump?

Dem go swear in Donald Trump into office for di inauguration ceremony on Monday 20 January 2025.

Bifor dat, however, di electoral college come into play. States don give certain number of electoral votes based on dia population. Dem award all of dia electoral college votes to whoever win di most vote in each state.

Dem confam dis afta meetings on 17 December.

Di new US Congress go meet on 6 January to formally count di electoral college votes and confam di new president.

Latest article