Video: Kamala Harris call Donald Trump to concede defeat
Vice President Kamala Harris don concede defeat in di US presidential election to Donald Trump for her speech for Howard University in Washington DC on Wednesday.
Harris wey bin dey hope to become America first female president, tell her supporters say she don call Trump to congratulate am.
“Earlier today, I tok wit President-elect Trump and congratulate am on im victory.
“While I concede dis election, I no concede di fight wey many for dis campaign,” she tok.
Oga Trump regain di White House afta e secure victories in di key swing states of North Carolina, Georgia, Pennsylvania, and Wisconsin, as many pipo project.