Wednesday, October 23, 2024

Explosion in turkey: Wetin we know so far about di attack on Aviation company for Ankara – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

Turkey minister of interior say some pipo don die and odas injure afta one explosion outside di headquarters of one Turkish aviation company near Ankara.

Ali Yerlikaya call di incident outside Turkish Aerospace Industries (TAI) “terrorist attack”, as im add say “unfortunately, we get martyrs and injured pipo”

Im no tok di exact number of pipo wey don “die or injure” but promise to continue give di public informate about developments. E also encourage make pipo only rely on official sources for information

Local tori pipo bin report one blast and shooting outside di site wey dey about 40km (25 miles) outside Ankara.

Di place wey dey under attack na di headquarters of TAI for Kahramankazan, around 17 miles (28km) for north west of Ankara.

According to di aerospace company website, di campus covers area wey reach about 1.5 square miles (4 sq km).

E never clear exactly wia and wetin dem attack for di very big site.

Latest article