Thursday, October 17, 2024

Kamala Harris Bret Baier Fox News interview in four short points – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Harris call Trump a threat as she separate hersef from Biden

Ahead of di US Presidential election, di Democratic White House nominee Kamala Harris do her first-ever interview with Fox News.

She clash many times with di presenter on issues like transgender prisoners, illegal immigration and President Biden mental fitness.

During di interview, di US vice-president and Bret Baier dey interrupt each oda, e reach one point wen Harris para wen she tok say: “I dey for di middle of responding to di point wey you dey raise and I go like to finish.”

Her attack on di network wey dey host some of her most vocal media critics dey come as opinion polls show say majority of male voters dey support her Republican rival, Donald Trump, ahead of di election next month.

Dis gender gap don dey even enta into her main electoral coalition, including younger voters, blacks and Hispanics.

Meanwhile, Trump bin show face on Fox on Wednesday, for one town hall-style event wey all di pipo wey attend na females as im dey work to tackle im own political vulnerability with women voters.

See some of di issues wey Kamala Harris tok about.

Harris separate hersef from Biden

Afta Fox bin play on clip from one interview wey she bin give last week wia she tok say “notin dey wey ” she go like to change about di actions of di Biden-Harris administration, Harris continue to tok further dan wetin she don tok bifor as she bin dey try to put some gap between hersef and her oga.

“Make I dey veri clear, my presidency no go be a continuation of Joe Biden presidency,” she tok on Wednesday, but she no explain am in detail.

Baier press Harris on her belief say American voters no wan “go back” to Trump, and weda pipo wey kontinu to support di former president dey “stupid” or “misinformed”.

“I no go eva tok dat kain tin about di American pipo,” Harris answer.

Baier also press her on why one of her campaign promises na to “turn di page” wen she don be vice-president for more dan three years.

Harris start to criticise Trump.

Gender surgery for prisoners

Dem ask Harris about taxpayer-funded gender reassignment surgery for prisoners, one policy wey she bin don tok say she support in di past.

Dem ask her if she as president go advocate say make dem use taxpayers dollars for gender reassignment surgery, she answer say: “I go follow di law.”

Wen dem ask her to give more details, she say surgeries like dat bin dey available to prisoners wen Trump bin dey office.

However, no transgender surgeries happun for di federal prison system wen Trump be president.

Di Federal Bureau of Prisons tell BBC Verify say two federal inmates don do gender reassignment operations – di first one happun for 2022 and di second happun for 2023.

Wen Harris bin dey contest as a Democratic candidate for president for 2019, she bin tick one box for one questionnaire from one civil rights group wey show say as president, she go use her authority to make sure say pipo wey identify as transgender-wey dey detention for prison and immigration facilities go get access to “treatment wey dey associated with gender transition, including all necessary surgical care”.

Na wetin di Harris campaign bin tok “no be wetin she dey propose or running on” for di 2024 election.

Harris dey challenged to apologise

Di vice-president interview bin start with di subject of immigration, wia Baier play one emotional clip for her wey show di mother of Jocelyn Nungaray, one12-year-old girl wey one migrant kill wey bin illegally cross di border into di US wey dem bin release from detention.

Dem ask her weda she go apologise to di families of Americans wey illegal migrants don kill, Harris answer: “I dey sorry for her loss.”

“Dem be tragic cases,” she add. “Question no dey about am.”

Baier also ask about her 2019 stance about border crossings weda make e no be crime again. Dis na one of plenti issues wey pipo don accuse di vice-president say she dey flip-flop (change side evritime).

Harris say: “I no believe to decriminalise border crossings and I neva do am as vice-president, and I no go do am as president.”

She continue to blame Trump say im convince Republicans for Congress to vote down one border deal earlier dis year, she tok say: “Im prefer to run on a problem instead of fixing a problem.”

Harris dodge question on Biden mental state

Wen dem ask Harris questions about di mental health of President Joe Biden she divert di questions.

Dem ask her wen she first notice say Biden mental faculties “be like say e dey drop”, Harris say: “Joe Biden, I bin dey watch am from di Oval Office to di Situation Room, and im get di judgment… and experience to do exactly wetin im don do to make veri important decisions on behalf of di American pipo.”

Wen dem press her more on di issue, Harris answer say: “Joe Biden no dey for di ballot, and Donald Trump dey.”

Latest article