Friday, September 20, 2024

Paetongtarn Shinawatra: Former Thailand Prime Minister Thaksin Shinawatra daughter become youngest leader at 37 – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Thailand parliament don pick Paetongtarn Shinawatra as di new PM

Thailand parliament don pick Paetongtarn Shinawatra, di daughter of billionaire tycoon and former leader Thaksin, as prime minister.

At 37, she be di kontri youngest PM and di second woman wey go dey for di post, afta her aunt Yingluck.

Her selection dey come just two days afta former PM Srettha Thavisin bin dey dismissed by one constitutional court. Both of dem come from di Pheu Thai Party, wey come second for di 2023 election but form a ruling coalition.

Ms Paetongtarn na di fourth member of di Shinawatra clan to become prime minister in di past twenty years.

Di oda three, including her papa Thaksin and aunt Yingluck, bin dey deposed by military coups or constitutional court rulings.

Ms Paetongtarn receive 319 endorsement votes for parliament on Friday, while 145 MPs bin vote against her.

On Thursday, she tok say she admire Mr Srettha work and tink im dismissal dey unfortunate.

“We gada here today to show di pipo say we dey determined, driven and ready to push di kontri forward,” she tell reporters for her party headquarters, wia dem put am forward as PM candidate.

She dey educated for elite schools for Thailand and attend university for UK. Ms Paetongtarn spend some years working at di Shinawatra family Rende hotel group, where her husband serve as deputy chief investment officer.

She join Pheu Thai for 2021 and dem appoint am as party leader for October 2023.

Ms Paetongtarn priority as PM na di same as di previous administration – to revive economy wey don dey stuck in low growth for many years.

But her opponents, both inside and outside di ruling coalition no go want her to succeed to di extent say Pheu Thai become once more di unbeatable election-winning machine wey e be bifor.

And all di time, she go dey watch ova her shoulder for possible intervention by Thailand unelected institutions.

Her party hope say she go also bring fresh energy to restore dia political fortunes.

Mr Thaksin first become prime minister for 2001, but im second term for office end abruptly afta one military coup depose im goment for 2006. E return to Thailand afta 15 years for exile last October, hours bifor dem vote Mr Srettha as prime minister.

Latest article