Thursday, September 19, 2024

2024 Iranian strikes against Israel: Which kontris don ask dia citizens to leave Lebanon and why? – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Many commercial airlines don stop to dey operate flights to and from Lebanon

  • Author, Tom Bennett
  • Role, BBC News
  • Reporting from London

US don urge dia citizens to leave Lebanon on “any ticket available”, as fears dey grow say di war for di Middle East fit spread.

UK, Sweden, France, Canada and Jordan and an increasing number of kontris don also issue similar warning.

Iran don vow “severe” retaliation against Israel, wey dem blame for di death of Hamas, chief Ismail Haniyeh for Tehran on Wednesday.

Im assassination come hours afta Israel kill Hezbollah commander Fuad Shukr for Beirut.

Western officials fear say Hezbollah, one Iran-backed militia and political movement wey dey based for Lebanon, fit play heavy role in any of such retaliation, wey in turn fit spark serious Israeli response.

Di US embassy tok on Saturday say make those wey choose to remain for Lebanon “prepare contingency plans” and make dem dey prepared to “shelter in place for an extended period of time”.

Dem tok say several airlines don don suspend and cancel flights, and many flight tickets dey sold out sold out, but “commercial transportation options to leave Lebanon remain available”.

Some ticket prices don increase very high, but no signs say pipo dey panic or rush to leave dey.

Hezbollah launch dozens of rockets for di town of Beit Hillel for northern Israel at around 00:25 local time on Sunday (21:25 GMT Saturday) .

Footage wey dem post on social media show as Israel Iron Dome air defence system intercept di rockets. Reports of of casualties neva dey.

Israel air force bin respond by striking targets for southern Lebanon.

On Sunday morning, dem stab and kill two pipo for di Israeli city of Holon. Police tok say dem later “neutralise”, di attacker.

Wetin we call dis Video, Watch: Israel intercepts many rockets fired from Lebanon

Fears of escalation of hostilities wey fit engulf Lebanon dey for dia highest since Hezbollah start dia attacks on Israel, a day afta di deadly Hamas attacks on southern Israel on 7 October, to show support for Palestinians wey dey for Gaza.

Dem don contain most of di violence to border areas, as both sides dey show say dem no dey interested for very bid kasala.

Hezbollah, however, don vow to respond to Shukr assassination, wey happun for Dahiyeh, di group stronghold for Beirut southern suburbs.

Di Pentagon say dem dey deploy additional warships and fighter jets to di region to help defend Israel from possible attacks wey Iran and dia allies wan carry out.

UK say dem go send extra military personnel, consular staff and border force officials to help wit any evacuations – but urge UK citizens to leave Lebanon “while commercial flights still dey operate”.

Two British military ships don already dey di region and di Royal Air Force don put transport helicopters on standby.

UK Foreign Secretary David Lammy say di regional situation “fit deteriorate rapidly”.

Meanwhile for Gaza, one Israeli strike kill at least 17 pipo for one school wey dey shelter displaced pesins, di Hamas-run authorities tok on Saturday.

Di Israeli military say dem dey use di Hamama school for Gaza City for Sheikh Radwan neighbourhood as command centre for militants.

Hamas deny am, dem say dem no dey operate from civilian facilities.

Dem send Israeli ministers go house dis weekend wit satellite phones in case of an attack on di kontri communication infrastructure.

For April, Iran bin launch one air attack on Israel, dem use 170 drones, 30 cruise missiles and at least 110 ballistic missiles.

Dat happun afta Israel bomb one Iranian Consulate for Damascus, Syria.

Many pipo dey fear say Iran retaliation on dis occasion fit take similar form.

For one fone call wit EU Foreign Policy Chief Josep Borrell on Friday, Iran Acting Foreign Minister Ali Baqeri Kani say Iran “no doubt go use dia inherent and legitimate right” to “punish” Israel.

On Friday, one announcer on Iran state TV warn say “di world would go witness extraordinary scenes”.

Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu don warn Israelis say “challenging days lie ahead… We don hear threats from all sides. We dey prepared for any scenario”.

Tensions between Israel and Iran initially escalate wit di killing of 12 children and teenagers for one strike on di Israeli-occupied Golan Heights.

Israel bin accuse Hezbollah and dem vow “severe” retaliation, though Hezbollah deny, dem say dem no get hand for di mata.

Days later, senior Hezbollah commander Fuad Shukr was die for inside one targeted Israeli air strike for Beirut. Four odas, including two children, also die.

Hours after dat, Hamas chief Ismail Haniyeh dey assassinated for Iran, Hamas main supporter.

E bin dey visit to attend di inauguration of Iran new president, Masoud Pezeshkian.

Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei, don tok say Israel willgo suffer “harsh punishment” for di killing.

Latest article