Thursday, September 19, 2024

Russian prisoner swap: Evan Gershkovich, Alsu Kurmasheva, Paul Whelan and odas go free for di biggest exchange between Kremlin and di West since di Cold War – BBC News Pidgin

Must read

Wia dis foto come from, Reuters

Turkey presidency say twenty-six prisoners from seven different kontris na im dem don exchange for di kontri capital Ankara.

Di prisoners come from United states, Germany, Poland, Slovenia, Norway, Russia, and Belarus, e tok for one statement.

On Thursday afternoon GMT, one Russia plane land for Ankara, not long afta Turkey National Intelligence Agency (MIT) say na dem go coordinate today exchange.

“Our organisation don undertake one major mediation role for dis exchange operation, wey be di most comprehensive of di recent period,” di intelligence agency say.

Ten pipo, including two children, na im dem relocate go Russia, 13 prisoners go Germany, and three go America, di statement add.

Who be di prisoners wey involve for di swap?

Earlier, di speculation bin be say na Russia, United States, Germany plus three oda western kontris go release plus swap 24 prisoners on Thursday under one prisoner exchange deal

Three US citizens, Wall Street Journal reporter Evan Gershkovich, US Marine veteran Paul Whelan, and Russian-American radio journalist Alsu Kurmasheva, na dem one senior US official say dem bin dey expect say dem go release for dis deal wey Biden agree to.

Turkey statement confam say Gershkovich and Whelan follow for di pipo wey dem release. Also, dem release German mercenary Rico Krieger, wey bin dey prison for Belarus, and Russian opposition politician Ilya Yashin.

For im statement, US President Joe Biden describe di exchange as “a feat for diplomacy,” come confam say four Americans, Paul Whelan, Evan Gershkovich, Alsu Kurmasheva, and Vladimir Kara-Murza dey “finally come home”.

Earlier dis week, Belarus leader Alexander Lukashenko pardon one German citizen Rico Krieger wey dem bin sentence to death for terrorism plus oda charges.

Ilya Yashin bin sure say im go land for prison wen full-scale invasion of Ukraine begin – becos im condemn am.

Di goment sentence am for spreading ‘false information’ about di Russian military.

Dem charge am base on one YouTube stream, wia Yashin discuss di killing of civilians for Bucha, outside Kyiv. Court sama am eight and a half years.

Dis release of 26 prisoners na one of di biggest exchanges between Russia and di West for history.

For now e never clear di identity of all di 26 pipo wey dem exchange but dis na some of di pipo wey suppose follow.

Vladimir Kara-Murza, one Kremlin opposition wey get Russian-British citizenship, follow among di pipo wey dey detain, but nobody sabi wia dem carry am go. Dat na why pipo dey expect say im fit follow among di pipo wey dem go release.

Russian-American journalist Alsu Kurmasheva chop six-and-a-half years prison sentence for one Russia court last month.

Kurmasheva, wey get both US and Russia citizenship, chop charge for spreading false information about di Russian army.

Her colleagues for US-funded Radio Free Europe/Radio Liberty (RFE/RL) say dem arrest di mother of two last October for failing to register as foreign agent wen she dey visit her family for central Russian city of Kazan.

Eight Russian pipo dey expected to return to Russia. Some dem dey suspect say get sometin to do wit Russia intelligence.

One of dem na Vadim Krasikov, wey German officials identify as colonel for Russia FSB intelligence service.

Krasikov bin dey serve life sentence for di 2019 murder of one Kremlin opponent for Berlin Park.

Latest article